
Wia dis foto come from, Portable Baby/Carter Efe/Facebook
8 minutes wey don pass
Read am in 3 mins
Content creator and streamer Carter Efe beat singer Portable for celebrity boxing bout wey happun on Friday 1 May.
Di bout happun for Federal Palace Hotel for Victoria Island area of Lagos, southwest Nigeria.
Celebrity boxing for Nigeria don dey gain ground for di kontri. Wetin be casual exhibition bouts between influencers don draw organised audiences, structured judging, and growing media attention.
Organisers title di Carter Efe vs Portable bout as “Chaos for di Ring 4”.
Di bout no be just about bragging rights, e bin reflect how Nigerians don dey take dis contests serious.
Portable bin enta di ring with reputation wey e already build from previous wins.
E bin previously beat Charles Okocha.
But di Zazu crooner no fit replicate previous feats as Carter Efe defeat am.
Dis na how di fight bin go down.
For opening round, di Portable, use in normal gra-gra fighting style to dey throw any how blow but bicos Carter Efe na di taller one in di match, e just chop di blow witout too much moves.
Efe bin respond to di move wit im own uppercuts and bodi punches wey really affect Portable as na im small pass for di match.
For round two, Portable still dey use im gra-gra style to continue for di fight but as for Carter Efe, e change tatics.
Tri be di content creato turn streamer start to dey land more precise combinations as e start to dey reason di game sharp.
For di thrid roud, Efe don alreadi master how to dey land im blow wella for Portable bodi bifor dem come ring di final bell.
Carter Efe win dis fight wit unanimous decision of 27-30 from di three judges of di match to put di streamer as di winner of di match.
Di match bin dey livestreamed for livestream subscription based platforms
Skip X postAllow X content?
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.
Accept and kontinuWarning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Wetin dey ginger di hype around celebrity boxing for Nigeria
Well di hype for celebrity boxing bin enta Nigeria aroud di time wen Detty December start to dey pop and Nigerians try to dey use di opportunity to drag di amount of tourists wey dey visit to different events.
Normal-normal street boxing don dey part of street culture like pikng pong or ludo, howeva, for 2023 December wen e turn anoda tin.
Balmoral Promotions wey be one of di promoters for dis Portable vs Carter Efe match don dey run weekly fights for di yard.
Meanwhile Amir Khan wey also be one of di promoters also don dey run events of Lagos since 2025 October wen e host two American boxers.
Khan wey be Olymic medalist for boxing bin tell BBC Sports say im plan na to ginger boxing for Africa and di Middle East bifor e go come enta di UK circuit.
E tok say “Why Africa? I tink say na untouched market.”
Dis fight na one of di fight wey don draw attention for di Choas in di RIng series. Tori be say di Nigerian Boxing Assoiciation bin sanction di fight.
